Mind Your Business

Falz, Simi

Hello
Hello how far
I get gist for you o
Ah what's up
You know that girl with 20k followers on IG na
Which one
Dat girl that is always shaking her bum bum dat is always doing oh keep popping
Dat girl suppose they carry filter anywhere wey she dey go o
Hehe why na
Omo baba na scam
Ehn

Why you too dey talk o
Shey you no dey tire
Ejo e nle njo wey no concern you
Na there dem go find you
You no get work o

Na for your mouth dem go hear say Simisola get belle
She don get belle
Na for your mouth them go hear say Biliki dey sell pepper
She sell pepper o
Na for your mouth dem go hear am
Busy body don come may you fear am
Uncle face your work o

Mind your business
Mind your business
Who say make you no mind am
Mind your business
Busy body o
Mind your business
If you no like am
Mind your business

Na lie
I no fit lie give you na Kemi sef dey there
I dey there
Her makeup don wash finish
Nothing to write home about
No be that one come pain me pass o
Na that her boyfriend

Well done sir
Mr talker eku ise
Mr wetin no concern me reporter dat's right
Simi don marry Adekunle but why was Falz invited
How is that your concern short up
Why don't you face your work aunty Uche
You go chook your mouth everywhere like ekute wo wo
You no dey let sleeping dog lie
Sweetheart Shey you know say na curiosity wey kill cat
Leave talk leave amebo leave chat face front
Find business wey you fit start fit start
Take tea. Drink that mind your biz wax
Open your ear when you're listening to this track
Na for your mouth them go hear she buy three cars
But say she just use her mama do ritual amebo
You say Sade just dey reach 32 years
But she never still marry make she do fast

Mind your business
Mind your business
Who say make you no mind am
Mind your business
Busy body o
Mind your business
If you no like am
Mind your business

Wait o
No be that her boyfriend wey dey give am Porsche assurance
Believe you me
Wetin I see no be Porsche assurance na okada assurance
Jesus
God save us dear

You dey put your mouth uhm alakori oh
For the thing wey no concern you thing wey no concern yo
Aabosi ooooo
The thing wey you dey find go find you

Mind your business
Mind your business
Who say make you no mind am
Mind your business
No be by force oh
Mind your business
If you no like am
Make you Mind your business
Ole

Wissenswertes über das Lied Mind Your Business von Simi

Wann wurde das Lied “Mind Your Business” von Simi veröffentlicht?
Das Lied Mind Your Business wurde im Jahr 2019, auf dem Album “Omo Charlie Champagne Vol. 1” veröffentlicht.
Wer hat das Lied “Mind Your Business” von Simi komponiert?
Das Lied “Mind Your Business” von Simi wurde von Falz, Simi komponiert.

Beliebteste Lieder von Simi

Andere Künstler von Contemporary R&B