I Don Blow

Sayo Pisanta, Timaya

Uru ga gbu mmadu le
I don come again oh
Timaya match up the place oh (Oh oh oh)
Everybody say
Well I say na who be the baga
Everybody say na who be the maga (Eh eh eh oh oh)

Everybody everybody say
I don show I don show
Aproko people I won make una know
See all the way from Port Harcourt
I break into their Lagos market
See some people don dey vex
Eh my brother man me I come here to flex
See it's the gift and the grace eh
Why I blow today na by en grace eh

Some people wanna write about me
Everybody say we all na human being
So tey dem say I dey smoke marijuana
This marijuana don make me dey hamma

I get one tori for you eh
I go dey sing and everybody go dance eh
But I get one thing for you (Oh oh, oh oh)
Whether you like am, oh oh
Whether you no like am, oh oh)
Timaya don blow oh oh
I don blow oh oh

Whether you like am, oh oh
Whether you no like am, oh oh
Timaya don kpolongo oh oh
I don kpolongo oh oh

Some say I too dey big up my chest
Everybody just begin to confess
Anywhere I waka oh dem say I be the best
Say my brother man my style is different from the rest

Eh egberi papa one of Bayelsa
Anytime I enter enemies dey scamper
Eh eh na fire fire eh
Mama and papa wanna kpaya kpaya eh

If nah lie them know me wella
Everybody make una stroll to bayelsa
Make you ask Goodluck Jonathan
Tinipiri silver na me be the master

I came and I saw and I conquered
I decide to change my name to timaya
Yaba, alaba, the king of commercial
Eh ay king of commercial

Whether you like am, oh oh
Whether you no like am, oh oh
Timaya don blow oh oh
Me I don blow blow blow oh oh
Everybody say you like am, oh oh
Whether you no like am, oh oh
Timaya don blow oh oh
I don kpolongo oh oh

I make many artists go back to their city
Write better rhyme and do better beat
Everybody im physically fit
Musically my guy I swear I dey fit

Make I give you some lectures
Musically my guy na me be professor
Eh everybody hiphop hurray
Dem mama dem mama chineke mu eh

Shayo master give them the magic shayo be santa
Give them the magic eh
Robo robo shikaraba
Dengo robo nibo robo Shikaraba dibaraba eh ah

I say Shayo master give them the magic
Show dem, give them, show dem the magic eh
Riba raba ribaraba Senkerebe ribayaba Shapuriba
Whether you like am, oh oh
Whether you o like am, oh oh
Timaya don blow oh oh
Me I don blow blow chinekeme oh oh
You like am, oh oh
Whether you no like am, oh oh
Timaya don kpolongo oh oh
Kpolongo oh oh

See some people say make I start collabo
But dem no know say collabo follow for promo
Dem say make I try to come out with my own
So that everybody go know say me I be pro eh

Dem say me I no go fit do am again eh
I don come to put bad belle to shame eh
Chai I dey come with the hook
The next thing everybody go call me a crook

Its not by my power eh eh
Its not by my might eh
Na Jehovah dey do am eh eh
Na me be my ogologon na my God eh

I say not by my power eh eh
Its not by my might eh
Na Jehovah dey do am eh
Everything I get for this life eh

Whether you like am, oh oh
Whether you o like am, oh oh
Timaya don blow oh oh
I don kpolongo oh oh

Everybody say you like am, oh oh
Whether you no like am, oh oh
Me I don blow, I don blow, I don blow

Men I don blow you can't stop me
Im a moving train men I move I move I move
I keep moving moving (Ha ha)

Chai everybody say
You cannot stop me eh
You no go fit stop me eh
Im a moving train eh
Im sent by God to tell una eh

Everybody just thanks eh
Everybody juts flex eh

Wissenswertes über das Lied I Don Blow von Timaya

Auf welchen Alben wurde das Lied “I Don Blow” von Timaya veröffentlicht?
Timaya hat das Lied auf den Alben “Gift and Grace” im Jahr 2008 und “Best Of Timaya” im Jahr 2014 veröffentlicht.
Wer hat das Lied “I Don Blow” von Timaya komponiert?
Das Lied “I Don Blow” von Timaya wurde von Sayo Pisanta, Timaya komponiert.

Beliebteste Lieder von Timaya

Andere Künstler von African hip hop