Target You

2Baba, Syemca

Eh eh I no go lie I dey see you too
It all depends on what you wan do
No pretend make you just stay true
As e dey do me na so e dey do you
I no go lie I dey hala everyday
I wonder why you no dey look my way
Abi e get something wey I never do
Abi you want make I summersault too

Abi you get another pattern wey I never know
Make you tell me make I do the needful
Life is too short baby report
Make na me and you be our life support
I don't wanna be a faithful pervert abi you never know
See I just wanna be a simple lover say na so the thing go

E get why I dey target you
You different from the whole of your crew
E get the way you dey look me too
And that is why I dey suspect you
I know you want for us to prepare
I know you wan know wetin dey my head
See this loving I want it trending
And it would be blissful too

Oya baby kia kia make we link up
Make oju kokoro people no come dey snatch us
I guarantee you I go always defend us
As I go love you e go make people jealous
I just wan roll just me and you eh
Forget whatever them do you
Abi e get another pattern wey I never see
Anyhow you want am I got you and me
I don't wanna be a faithful pervert abi you no go like to know
See I just wanna be a simple lover ah no let the thing go

E get why I dey target you
You different from the whole of your crew
E get the way you dey look me too
And that is why I dey suspect you
I know you want for us to prepare
I know you wan know wetin dey my head
See this loving I want it trending
And it would be blissful too

Na peaceful chilling around my way
Good good loving for you all the way
Abi e get another pattern wey you wan see
Make you tell me make I show you for free
I don't wanna be a faithful pervert ah I don't want to be that for sure
See I just wanna be a simple lover ah baby let this love flow

E get why I dey target you
You different from the whole of your crew
E get the way you dey look me too
And that is why I dey suspect you
I know you want for us to prepare
I know you wan know wetin dey my head
See this loving I want it trending
And it would be blissful too

Eh eh e get as you dey do me
E get as you dey do me
E get as you dey do me make sense zeeno foster
Eh eh e get as you dey do me
E get as you dey do me
E get as you dey do me
Eh eh in fact just leave am like that
Anything wey you choose to do eh na your hand e dey na

Wissenswertes über das Lied Target You von 2Baba

Wann wurde das Lied “Target You” von 2Baba veröffentlicht?
Das Lied Target You wurde im Jahr 2020, auf dem Album “Warriors ” veröffentlicht.
Wer hat das Lied “Target You” von 2Baba komponiert?
Das Lied “Target You” von 2Baba wurde von 2Baba, Syemca komponiert.

Beliebteste Lieder von 2Baba

Andere Künstler von Afrobeats