Black Man, Black Woman

ASHIMI IBRAHIM

This love from the very beginning na taboo

I dey for you
You dey for me
Like the sun and the earth

And this kind of responsibility
Na for few

We carry our matter ah
For head

If na the days of our fore fore fathers
The way we dey live dem go call us Messiah
Like Amadioha
Like Sango and Oya

But I be black man
I bend the whole town
To impress some crazy clown
Wey dey spread the hate around

Black man
I own the whole town
To impress some silly clown
Wey dey spread the hate around
I forget to care for my own
I carry the problem of the world
But I no care to solve am for my own

I dey show I dey buy I dey owe
Na society dey enforce the rules
But na woman dey dictate the rule
Na wetin man go do
Na to break the rules but for good

And you be black woman
You wear your pain like amour
You take your luck and lock up
You say na man get the fuck up

Black woman
Na you get the whole town
To impress some silly clown
Wey dey spread the hate around
You forget to care for your own
You carry the problems of the world

But you no care to solve am for your own
You dey you dey jolly
You dey pose

Wissenswertes über das Lied Black Man, Black Woman von Brymo

Wann wurde das Lied “Black Man, Black Woman” von Brymo veröffentlicht?
Das Lied Black Man, Black Woman wurde im Jahr 2020, auf dem Album “Yellow” veröffentlicht.
Wer hat das Lied “Black Man, Black Woman” von Brymo komponiert?
Das Lied “Black Man, Black Woman” von Brymo wurde von ASHIMI IBRAHIM komponiert.

Beliebteste Lieder von Brymo

Andere Künstler von