Pim Pim

EZENWA OGBONNA, OLAWALE OLOFOORO

When them ask wetin you fit do for here
Inspiration go pull you through them go hear
Dem dey lose themselves to break you here
You hip you hop you no bruise for where

The forces dey behind you my dear
Even your misadventures bear good fruit well
Intentions pure go guide me there
Love na my parlor do here

No listen pim pim
Deliberate work dey pay listen
Follow your heart e no easy
Life not harder oduimi

No listen pim pim
Detractors detract listen
Na toxicity be the reason
Be real na backbone for good thinking

The matter plenty and the truth there
But every turn na your own too my dear
No let greed trample the truth you hear
Life dey sing your favorite tune you dey hear

No listen pim pim
Deliberate work dey pay listen
Follow your heart e no easy
Life not harder oduimi

No listen pim pim
Detractors detract listen
Na toxicity be the reason
Be real na backbone for good thinking yeah

Survival get hin own rules yeah
Hear your words before you spew them
Check your history the truth full there
Inspiration dey guide you through there

No listen pim pim
Follow your own rules strictly
Deliberate work dey pay listen
To betray self na high treason

No listen pim
Advise wey bitter the truth e be
You dey hunt corruption for my country
Nearly everybody go go prison
No listen pim

Wissenswertes über das Lied Pim Pim von Brymo

Wann wurde das Lied “Pim Pim” von Brymo veröffentlicht?
Das Lied Pim Pim wurde im Jahr 2022, auf dem Album “Theta” veröffentlicht.
Wer hat das Lied “Pim Pim” von Brymo komponiert?
Das Lied “Pim Pim” von Brymo wurde von EZENWA OGBONNA, OLAWALE OLOFOORO komponiert.

Beliebteste Lieder von Brymo

Andere Künstler von